Abeg, shey na pesin future
Wey dis people dey tie im leg so?
Na pesin destiny
Wey dey waka go where im no know like dis so?
Awa tomorrow
Na im dem don give K-leg like dis?
Dis awa struggle
Na im dem dey take dey do kurukere so?
Di people wey bin call demsef our papa
Na dem still dey try cut awa dada.
Dis people wey bin talk sey we be leaders of tomorrow
Na dem still dey cover awa eyes make we no see daybreak.
Dis people wey yan sey dem wan see us progress
Na still dem dey feed on awa progress
We beg dem for peace of mind
But dem carry gunshot kom meet us for awa domot.
Dis national cake
Na im dem don privatize like dis?
Dis public fund
Na im dem don individualize so?
All awa country money
Na im dey swell for their belle so?
If awa country no gree stand again
Na dem we go hold responsible.
Na dem!
Ayogu Emmanuel Uchenna is a 300 level student of English and Literary Studies, UNN. Writing is what he enjoys doing the most when he is not studying, listening to melodious songs or hanging out. His environment serves as a source of inspiration to his poetry, as he believes in the cliché that “a writer works even when looking through the window”. He is an ambivert and when he feels lonely, his pen and blank pages serve as his companion.