Belle don turn noting, like zero-zero-zero.
Belle no dey see food; no crayfish, no seafood.
And the children for yard don dey use sand do
sandwich.
Take stick do spoon, say na yard-stick to chop
rubbish.
The matter get as e be, na why Martha carry
belle,
Make e be sey her empty belle go carry
weight small.
Pikin wey no see food chop, no need workout
for flat tummy
but now, shey nah small pikin dem dey call
mummy.
Belle don turn nothing: our girls still dey born
throway
children put for street wey dem go burn
throway;
Just after dem hala “thief! thief thief!”
Boys wey don taya for we Country, no dey
delay to put tyre
for another man neck: jungle justice every wia
but we no dey ever see those with the lion
share.
Belle don turn noting; And our girls still dey
travel
for night bus, make dem for chase dia dreams
cost the young shall grow but pesin
must chop fess.
So, she go follow any man with pot belly,
just to chop breakfast in bed.

Joseph Ekerette Udo aka Artitude is a Nigerian poet, writer and rapper..An art enthusiast and winner of the FASA War Of Words poetry Slam, University of Uyo, Akwaibom state, Nigeria. When he’s not writing poetry in his free time, he’s playing chess.